Sunday, November 23, 2025
illuminaija
No Result
View All Result
  • Home
  • Music
  • Foreign Music
  • All Songs
  • Download
  • DOWNLOAD MP3
  • Nigerian Songs
  • Biography
  • Dj Mix
  • Instrumentals
  • Net Worth
  • Freebeat
  • DCMA
  • Contact us
  • Home
  • Music
  • Foreign Music
  • All Songs
  • Download
  • DOWNLOAD MP3
  • Nigerian Songs
  • Biography
  • Dj Mix
  • Instrumentals
  • Net Worth
  • Freebeat
  • DCMA
  • Contact us
No Result
View All Result
illuminaija
No Result
View All Result
  • Home
  • Music
  • Foreign Music
  • All Songs
  • Download
  • DOWNLOAD MP3
  • Nigerian Songs
  • Biography
  • Dj Mix
  • Instrumentals
  • Net Worth
  • Freebeat
  • DCMA
  • Contact us
Home News

Coronavirus: Five confam ways wey sure to reduce di spread of COVID-19 infections

by Shiz
Sunday, 23 November 2025, 10:06 pm
in News

image

Coronavirus don dey spread worldwide, and e don cause fear-fear around di planet: thousands of new cases and hundredS of death naim dem dey announce every day.

Many cities and even kontris don dey for lockdown, and flights don cancel, not to mention international events and annual festivals.

Europe don become di new centre for di disease, while for Latin America, di US and Middle East, di infection dey spread like say tomorrow no dey.

Car companies go convert dia factory to make ventilators
Coronavirus: How to ‘self-quarantine’ and why e dey important now
But some kontries don manage to contain di spread.

“Kontries wey don manage to match brake ontop di outbreak and I feel say we suppose learn from dem,” na so epidemiologist Tolbert Nyenswah, wey be professor for Johns Hopkins University for US, tell di BBC.

China neighbour Taiwan, for instance, wey get population of 23.6 million only report 215 cases of coronavirus and two deaths as of 25 March.

According to Nyenswah, kontries like Taiwan, Japan and Hong Kong slowdown coronavirus because dem respond quick quick and dem use ogbonge policies.

Dis na di ones wey don work well-well:

1. Test, test and then test again

Di World Health Organization (WHO) and sabi pipo wey follow di BBC tok gree say early detection na important tin in order to reduce di spread of di pandemic.

“You no fit know di impact of di virus or take action if you no sabi how many pipo dey affected,” tok Nyenswah.

Krys Johnson, Professor of Epidemiology for Temple University (USA), gree.

Broiler chicken dey cause Coronavirus?
Chloroquine fit control Coronavirus?
E tok say dis na wetin dey make real difference: kontries wey no dey test well-well begin get low number of cases while di kontries wey take testing play get increase of cases.

“South Korea don dey test about 10,000 pipo a day wey mean say dem dey test more pipo in two days than di whole of US dey do in one month,” im tell di BBC.

WHO Director General Tedros Adhanom Ghebreyesus tok say to dey test anyone wey get symptoms na di “key to stop di spread” of di pandemic.

2. Isolate pipo wey don dey infected

“South Korea and China don do excellent work to track, test, and contain dia citizens,” tok Prof Krys Johnson.

“Authorities go send pipo wey get high temperature to ‘fever clinics’ wia dem go test for flu or Covid-19.

If dem test positive for Covid-19, dem go isolate dem for wetin dem dey call ‘quarantine hotels’ in order to make sure say dem no infect dia families,” she tok.

Seven tins wey go happun during ‘total lockdown’ for Coronavirus
Buhari Chief of Staff, Bauchi Govnor don catch Coronavirus – Se how dem get am
Taiwan, Singapore and Hong Kong do dia own with different method: dem isolate suspected cases for dia own house and anybody wey break di rule to stay for house go pay fine wey pass $3,000.

3. Ogbonge preparation and sharp reaction

Nyenswah, wey don work before to prevent di spread of Ebola for West Africa, tok say one of di basic tins to reduce coronavirus na to take quick action, before pipo for kontri catch am.

For Taiwan, one health organisation wey get many research and goment agencies inside, don dey operate from di time of SARS infection crisis, wey don make dem prepare well-well for di current coronavirus.

Chloroquine fit control Coronavirus?
Celebrities wey don get Coronavirus
For Africa, Nigeria na anoda goment wey dey boast say dem sef dey ready to fight Covid-19 because of how dem manage march brake ontop Ebola, wey disturb di kontri well-well many years ago.

4. Social distancing

“Once di disease don dey already di kontri well well, containment plan no go work again,” says Nyenswah.

For dat time di method wey dey work well pass to protect di population na to practice social distancing – like di way Hong Kong and Taiwan do.

5. Good hygiene

WHO say to dey wash hand on a regular and good hygiene dey important not to spread di disease.

“Many kontries for Asia learn dia lesson from di SARS experience for 2003. Dem sabi say good hygiene dey make pipo not to catch disease and infect oda pipo,” says Nyenswah.

For kontries like Singapore, Hong Kong, and Taiwan different-different place to use antibacterial gel for streets boku and e no go hard you to find pipo wey facemask.

Although face masks fit no work well to prevent pesin to catch di disease but e dey help to reduce how pesin fit pass am through cough and sneeze.

Real Madrid kits 24-2025 For Dream League Soccer 2025
Tools

Real Madrid kits 24-2025 For Dream League Soccer 2025

Tools

First Touch Soccer 2025 (FTS 25) Mod Apk Obb Data Download

Tools

GTA 5 Apk Obb Data Latest Download For Android

ShareTweetPinSend
Previous Post

Isolation Has Turned Me Into A Bricklayer – Davido Reveals (Watch Video)

Next Post

COVID-19: Popular Pastor Beg Church Members To Pay Their Tithe Online Following Ban On Church Service (Video)

Shiz

Shiz

Related Posts

Two Coronavirus patients discharged in Oyo

Two Coronavirus patients discharged in Oyo

DJ Zinhle finally launch “EraVision” sunglasses

DJ Zinhle finally launch “EraVision” sunglasses

Christmas Day Tragedy: Hit-and-run driver kills OOU final year student, Boluwatife Oyeleye in Ajah (Photo)

Christmas Day Tragedy: Hit-and-run driver kills OOU final year student, Boluwatife Oyeleye in Ajah (Photo)

Watch an indignant Pope Francis smack woman’s hand to free himself from her grip

Watch an indignant Pope Francis smack woman’s hand to free himself from her grip

Jesus Fed The Poor, But The Poor Feed Pastors Today – Reno Omokri

Jesus Fed The Poor, But The Poor Feed Pastors Today – Reno Omokri

Japan completely lifts state of emergency in the country as COVID-19 outbreak is “brought under control””

Japan completely lifts state of emergency in the country as COVID-19 outbreak is “brought under control””

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No Result
View All Result

Recent Posts

Bongo Cat - Diamonds (Cover Version)

DOWNLOAD Bongo Cat – Diamonds (Cover Version) mp3

DOWNLOAD Dasmart – Life Drama mp3

DOWNLOAD Dasmart – Life Drama mp3

Rich Mavoko – Siwezi

DOWNLOAD Rich Mavoko – Siwezi mp3

Yo Maps – I Wanna Eat ft Stonebwoy

DOWNLOAD Yo Maps – I Wanna Eat ft Stonebwoy mp3

Tobi Akuraku – Ere Emi Ft Olabisi

DOWNLOAD Tobi Akuraku – Ere Emi Ft Olabisi mp3

Trending Posts

Jobs

Immigrate to Manchester, UK – Discover the bright future that awaits in Manchester

Immigrate to Manchester, UK – Discover the bright future that awaits in Manchester All kinds of emotions come alive during...

Read moreDetails
Pet Store Salesperson Need in Canada up to $3000 – Apply Now
Jobs

Pet Store Salesperson Need in Canada up to $3000 – Apply Now

If you are a lover of pets and want to make money, migrate to Canada Visa Free and work over...

Read moreDetails
Jobs : English teacher – college level needed in Canada by Okanagan College
Jobs

Jobs : English teacher – college level needed in Canada by Okanagan College

Jobs : English teacher – college level needed in Canada by Okanagan College DETAILS ABOUT THIS JOB English teachers are...

Read moreDetails
Jobs : Unskilled Jobs in Canada for Foreigners 2023 | With VISA Sponsorship
Jobs

Jobs : Unskilled Jobs in Canada for Foreigners 2023 | With VISA Sponsorship

Jobs : Unskilled Jobs in Canada for Foreigners 2022 | With VISA Sponsorship Looking For  Highly paid careers for unskilled...

Read moreDetails
Scholarships : University of Birmingham Undergraduate International Grants in UK 2022-2023
Scholarship

Scholarships : University of Birmingham Undergraduate International Grants in UK 2022-2023

Scholarships : University of Birmingham Undergraduate International Grants in UK 2022-2023 Wish to start your degree plan in the UK?...

Read moreDetails
INEC Adhoc Recruitment 2022/2023 Is Open (Apply Here)
Jobs

INEC Adhoc Recruitment 2022/2023 Is Open (Apply Here)

INEC Adhoc Recruitment 2022/2023 Is Open via www.pres.inecnigeria.org Portal: (APPLY HERE) INEC Adhoc Recruitment 2022/2023 Is Open via www.pres.inecnigeria.org Portal:...

Read moreDetails
Canada Scholarships : 2024 King’s University Undergraduate Scholarship Award in Canada
Scholarship

Canada Scholarships : 2024 King’s University Undergraduate Scholarship Award in Canada

Canada Scholarships : 2023 King’s University Undergraduate Scholarship Award in Canada Looking for scholarship grants in Canada? King’s University, Canada...

Read moreDetails
Harvard University Academy Scholarship For International Students
Scholarship

Harvard University Academy Scholarship For International Students

Harvard University Academy Scholarship For International Students Harvard University Scholarship is either external or internal. Internal scholarships at Harvard University...

Read moreDetails
Jobs : Breakfast attendant needed in Canada by Quality Inn & Suites
Jobs

Jobs : Breakfast attendant needed in Canada by Quality Inn & Suites

Jobs : Breakfast attendant needed in Canada by Quality Inn & Suites DETAILS ABOUT THIS JOB Breakfast Attendants are responsible for...

Read moreDetails
NPC Adhoc Staff Recruitment 2023 Application Form Portal (Apply Now)
Jobs

NPC Adhoc Staff Recruitment 2023 Application Form Portal (Apply Now)

NPC Adhoc Staff Recruitment 2023 Application Form Portal (Apply Now) NPC Adhoc Staff Recruitment 2023 Application Form Portal (Apply Now)...

Read moreDetails
  • Music
  • Foreign Music
  • All Songs
  • Download
  • DOWNLOAD MP3
  • Nigerian Songs
  • Freebeat
  • About Us
  • Submit Songs
  • DISCLAIMER
  • DCMA
  • PRIVACY POLICY
  • Contact us

© 2023 illuminaija

No Result
View All Result
  • Home
  • Music
  • Foreign Music
  • All Songs
  • Download
  • DOWNLOAD MP3
  • Nigerian Songs
  • Biography
  • Dj Mix
  • Instrumentals
  • Net Worth
  • Freebeat
  • DCMA
  • Contact us

© 2023 illuminaija